Opinions Influencers Stories

Chasing Small dreams

Chasing Small dreams
One day for hostel, my guy ask me say, "Bro, you get any online update?" I don dey shy to tell am before, but I think say, after all, we all dey hustle for money. I gather courage tell am, say, "Omo, I get one legit website wey dey pay." E quick ask me, "How much?" I tell am, "If you dey very active, you fit make like 50 to 300 naira per day."
E come ask me, "How long I go dey do am?" I tell am, "Na from 8am to 9pm, just 11 hour work." To my surprise, the guy burst laugh. He say, "Na all be this?" I come dey try explain give am again, I say, "Omo, you fit still make 3k every month if you serious, but you go first subscribe with 2k."

As I talk finish, the guy continue to dey laugh. He say, "You don finish look me finish, na this one you think say I dey find? Abeg, this kind level no reach for me." I try calm am down, I tell am, "Guy, na just side hustle o, nothing serious." But the guy no gree, he just dey laugh, say, "The least side hustle wey I wan do online now na 5k monthly. If na this one be your own, abeg, dey do am well."
At the end, I shame for myself as the guy waka commot. But anyhow, life go still continue. Na hustle we all dey, one day better go come. 😔

Show some love. Gift @davidez something as TIPs
489

Did you enjoy this story?

(and they will become your referrals here)
MindViewers is where you meet and gist with interesting people, while you get paid online for simple activities.
Comments
Please Login or Signup to react
OR
From
To
Load comments
Did you enjoy this story?

(and they will become your referrals here)
Login To Enjoy Full Access
MindViewers Icon
  • Daily login bonus: withdraw to bank or airtime.
  • Meet intelligent people; sharpen your intellect.
  • Exchange interesting opinions about current headlines.
  • List your expertise and get patronages.
  • Read Stories: people's daily gists and experiences.
| | | | | | Statistics | Advertise | About | Terms | Privacy