Home Opinions Market Stories

Shey na business Abi na wedding? 🤔

Shey na business Abi na wedding? 🤔
Oyana my people.
My story don land.

So, e get one family wedding wey i attend, e never too tay like that.
Hmm.... Omo! The drama no be here o 😳😂
The bride people and the groom people (families) just dey carry talk go left and right, front and back concerning the dowry o.

The bride' price list wey the bride people bring almost around 900k+, that's almost 1 Mili.... Apart from the clothes and some farmfood stuff wey the groom people dem bring.
Groom people say, e too high say them no fit pay am, say them don try, after all them don bring,
"ahn! ahn! Nawa ooh,"
"for this economy?"

Dem say wetin dem fit pay na About 500k+ ( because dem go through the list, commot wetin dey fit commot, mark the ones wey dem fit buy, subsidized the ones wey too much)

Hmm....bride people no gree oo, "say lai lai" them must do 90% of the list.

As dey come dey reach end of argument na, one of the bride uncle con bring list for the uncles & anunties of the bride.... Ahh!
Price list con almost dey pass the main bride price list. 😳
na so matter tie wrapper o (as for me, i just dey laugh, i no know why 😂)

Them con dey argue oo so tey, time con dey pass for other stuffs wey dem need to do.

Bride con dey cry, groom man sef con frustrate dyeee.... Because, the thing con be like say na im be the main topic of the wedding.
We don almost forget say na wedding sef 😂

Me now con dey wonder 🤔 "naija weddings these days, na really wedding abi na business?"
abi everybody dey look for who dem wan buy Benz on top their head... 😂

But anyways dem later settle matter sha, the papa of the bride vex talk say make them pay wetin dem get, say them go settle am among themselves.
So that, make wedding fit continue...

Naija we too like drama....😂

PS: give this post a thumbs up 👍 na you try pass

Show some love. Gift @blvck_boy something as TIPs
210
1 shares

Did you enjoy this story?

(and they will become your referrals here)
MindViewers is where you meet and gist with interesting people, while you get paid online for simple activities.
Comments
Please Login or Signup to react
OR
From
To
Load comments
Did you enjoy this story?

(and they will become your referrals here)
Login To Enjoy Full Access
MindViewers Icon
  • Daily login bonus: withdraw to bank or airtime.
  • Meet intelligent people; sharpen your intellect.
  • Exchange interesting opinions about current headlines.
  • List your expertise and get patronages.
  • Read Stories: people's daily gists and experiences.
| | | | | | Statistics | Advertise | About | Terms | Privacy