Them commot my Steeze -100%
As a kid then, many times we dey come village come do Christmas (you get?), but around 2011, this time we pack finally to come settle for village due to some crises then (in the northern part of Nigeria).
Me then, i dey new to the environment wey i come, new people, new food, new language, i been no fit speak the lang. then sef, i still dey speak my English, other children dey see me as celebrity 😂 you get!
Something happen, when them enroll us for the popular village school, me & my siblings with the person wey dey stay with my grandma that time, na us dey go school together, come back home together...
As time go on, i con dey make small small friends, wey later, them con dey teach me the way of the village, as an ajebo then, nothing i sabi, na to just dey speak big big English, so the thing dey vex them. 😅
Now the real gist. So one time after school, some of my friends wan go climb mango tree nearby the school.
People wey get the mango tree don' wan children of the school before i come say make nobody climb am. Me i no know.
Na so i say i must follow them make i experience how to climb mango tree,
Hmm... My siblings dem warn me make i no go, say dem go tell grandma, this & that..... I no hear o, that one no concern me, but i fear shaa, so i tell them make them wait for me, make i follow them go come, before i go join them make we go house.
As me & my friends reach the place, we begin climb carefully make nobody hear us, the tree big with different branches, na so small time, we begin dey swing am because e dey sweet us.
Me i go sitdown for one better branch up dey swing! swing!
.
Hmmmmmmm....... My people Before you hear jack Robinson....!
My friends con dey shout
"the owner dey come oo!"
"the owner dey come oo!!"
Ahh.... Everybody rush come down and ran. Me with one other guy, we no fit rush come down, (as per newbie na) 😂
Omo na from up the owner, with the palmtree stick wey she hold, begin dey lash us shege & banza comot from our body 😂
Oboi, worst part, my leg con stuck....😭
I dey receive beating, i still dey figure out how i go come down run, na so i jump come down, break leg small, stand up begin dey leap-run 😂 😭
Chaii..... I can never forget that day!
First time as an ajebo then to see shege.
But look at me now! 😂
Nigeria is showing me the real shege, if there another word under ajekpako (na im be my category) 😂
May God Revive our Economy, in where the hands of men has failed, AMEN!
.
Give this post a thumbs up! 👍
Thank You! 😍🙏