I first everybody
I be football lover, but i no be die hard fan oo..
I love to dey watch country 🇳🇬 football more than club....
So i dey support super falcons well well....🦅⚽
(Those girls too fine 😍 dieeeeee)
First time i watch them na 2018 WAFCON (Women African Cup of Nations Final)
And we win am against bafana bafana of south Africa.
Since then, any of their games i no dey miss am...
From 2019 FIFA Women's World cup to friendlies to 2022 WAFCON to 2023 FIFA Women World Cup (best memories)....
But I never go stadium before, 😂🙈 since dem born me.....
So one day, i been dey scroll social media when i dey read say dem get Paris Qualifier matches (like 3 matches) and one of them na home match (meaning dem go play am for Nigeria: Abuja Specially)
Ahh.....! I talk am for mind say na this one i must go, despite say then i dey work sef, i con dey think & reason 🤔 how i go take excuse for something else, make i go watch the match 😂
I was desperate because na against south African women, and i wan watch them too, those girls dey ball (i get crush for there, her name na Linda mothalo 😍 that lady too fine abeg)
Cut long story short, that day them con give us break for work..... (Hmm, na God do this one oo)
I prepare myself (with my backpack with lunch inside) i enter stadium around 11:00am.... For match wey dey start around 5:00pm 🥲🙆♂️😅 chaiii....
i no even reason this thing then sef, wetin concern me then, all i no be say make i first everybody enter stadium...
Only me just dey feel the stadium with amazement 😃😍 (as na my first time naa...) I waka the whole seat.....(no be everywhere shaa)
I waited till match start, (omo no be small wait oo, but i enjoy am)
And we won NGA 1:0 RSA through penalty.
PS: give this post a thumbs up 👍 na you try pass 🙏